long maxi wears which look beautiful

Episode 16
I was on my way home, when i
branch at one supermarket i ask
how much for catton of indomie
they said two thousand four
hundred naira, i went home and
check my wallet, money no dey,
na which kind wahala be this na
eh, i put a call to my loving
elder sister.
Sister B: hello
me: good evening ma
sis B: how you dey
me: i dey manage
sis B: na manage you dey
always dey manage, you nor
dey satisfy
me: hahaha when i finish school
then i go satisfy.
Sis B: so wetin you want this
time.
Me: na just small change.
Sis B: wetin una wan use am
do.
Me: we dey go for excursion
and e dey compulsory for
everybody because if we nor go,
we nor go fit report am.
Sis B: yes na true, na im make
you be science student, na how
much
me: na only eight thousand
naira
sis B: okay tomorow na sunday
i go send am for you on
monday.
Me: thats my loving sis.
Sis B: only when money is
involve abi?
Me: haa no oh, you nor say na
you be my second mother.
Sis B: na u sabi, i hope those
girls no dey disturb you for
there sha.
Me: no i still be virgin na, or you long maxi wears which look beautiful
nor trust me again?
Sis B: why not, you better
remain virgin because after
school na me go find woman
marry for you.
Me: and i hope you don dey find
down.
Sis B: no oh i dey wait make
you finish first.
Me: okay no problem i hope the
girl go fine like genevieve.
Sis B: no be about fine na about
character, i think say i don tell
you before, the beauty of a
woman is inside not outside she
said.
Me: okay i don hear bye bye
make i do assignment.
I cut the call, truly no be about
fine sha, if say na by beauty
lara for nor gree marry
oshiomhole na, but na because
of money lara marry
oshiomhole, so any one wey
she find for me, if e nor fine she
must get pepper.
I took my wallet and head to
first band opposite MCC road
there, i reach there omo see
que, the que long reach road
sotey them come bend like
snake, upon all say na 6 atm
matchine dey there oh ( i hear
say them don do three join), i
waited for my turn, while
waiting i receive a call from
adanna.
Me; hello hurney
adanna: how are you durley
me: am fine.
Adanna: were are you that place
look noisy.
Me: yeah am at first bank, trying
to withdraw some money.
Adanna: what do you need
money for?
Me: just to buy catton of
indomie
adanna: i see no problem,
please go home when you finish
in bank, when i come visit you
we will go and buy the indomie
together.
Me: yes my love.
Adanna: alright see you then
bye.
Me: alright take care.
I withdraw 2k remaining 1k for
my account, i went home direct,
to wait for adanna, when i get
home, i saw the padlock of my
door open, i open the door and
went in and there lay the
charming angel with two catton
of indomie on the floor.
I open my door and the
mysterious lady was sitting on
my bed mysteriously with two
mysterious catton of indomie on
the floor, she wore a short skirt
abi mini skirt, and a white
handless shirt, i walk in
majestically like a gentleman.
Adanna: hello durling (she said
standing up to meet me) how
are you.
me: am alright, i dont need to
ask you how you got my key,
but why didnt you tell me you
bought the indomie already (at
least i for no go withdraw that
small change wey dey for
pocket na)
Adanna: well i wanted to
surprise you. (she said, giving
me a peculiar kiss)
Me: and you did a hell of a job,
thanks alot dear ( i said settling
down on the bed with her)
Adanna: o come on you dont
need to thank me, if i dont take
care of you who will? (according
to ritababe).
Me: thats why am the luckiest
man in the world and am lucky
to have you.
She smiled as we sat down
together on my bed, no light for
house chai gbege ( and the one
wey she dress come like this
something must happen oh, and
my room wey dey hot like
hellfire when no light, she
brought hollandio yoghurt from
her bag and bread, we started
eating and discussing.
Me: i thought you dont eat those
type of foor.
Adanna: and what do you think i
eat?
Me: well maybe human blood or
flessh
she laugh out loud, oh god i so
much love seeing her laugh
with her sparking teeth like
diamond
Adanna: well you are right but
am not some kind of vampire or
cannibal, but those food am
eating mean nothing to me, i
just consume them to balance
your satisfaction, my real food
is live meat.
Me: live human? (getting scared
as if if she want eat me she for
never eat me since)
Adanna: yeah i mean like live
rat, frog and others.
Me: others like wat
Adanna: like human.
I was putting food in my mouth
when she mention human i
paused like somebody wey im
mama catch dey thief meat for
pot like cherrybrown ;D
Adanna: come on i was just
pulling your leg, i dont eat
human, if i do those guys that
attack you that, that body would
not have been found.
Me: what you did was hilarious
( i said calming down).
Adanna: yeah i know and i dont
regret it, something would have
happen to you if i didnt stop
them.
Me: but chinansa is wicked oh,
by the way its been long since i
saw her, i think she travel.
Adanna: yeah, she travel and
you will never see her again,
she said bowing her head in a
sorrowful way.

Stay tuned..........

_